No condition is permanent. I repeat am again..................... no condition is permanent.
This life no be pot of beans , sometimes, na mound of Pando yam . Na so I see one boy dey cry say no fish for him rice, another boy wey never chop since yesterday say make him bring the food.........the cry cry foolish boy no gree just use leg kick the hungry boy belle. Na him be say, person wey dey cry dey see road oooo. At least I no owe my landlord, you owe your landlord? My neighbor don turn storyteller on top rent matter - na so he be tell landlord how Okada break him yeye cousin leg, so him don spend all the money for ilaje people place to arrange him leg wey the bone almost pafuka.
My brother, I tire for this kind palava. Me sef no want pay landlord my last kobo wey I for use chop, but e be like say the man get juju - I no get time for long story with that him oversabi lawyer. I want even borrow that lawyer wig go another lawyer pikin wedding - The man too stingy,carry boys with eba muscle block road for wedding make person no come chop belle food. And i don help the craze lawyer before ooo, i help am finish seven bottles of Orijinal...........people dey always forget their friend in need.
See, this crazy driver nearly hit me. I no fit run for am, blood of Jesus cover me.
'Oga police , abeg cover that your mouth wey u dey use sneeze useless sneeze.' Na me talk am. I no dey owe anybody and I no commit forgery or thief thief crimes. I no dey owe billions of naira like some people wey get common sense, but no fit sabi pay money wey dem borrow with esusu.
I don tire, make I find otapiapia kill all those winch wey turn mosquito for my compound wey dey plan to come disturb God pikin sleep. I even see Iya kudirat face swell for morning after I slap that cockroach with my slippers. Ehn ehn, I no even see the second leg of that slippers again. I for just kill the cockroach.

One day,
I go just see money inside Ghana must go. I go pray before I go carry am. I go share give everybody. I no fit tell uche. Uche buy television no call me to come watch, no wahala! - I go just buy plenty drink, only me go enjoy.
Mary go come beg me to touch am again. I go do shakara.
I go pay that newspaper man wey dey always shout say make I comot for him paper stand because I dey win am for argument - The mumu say na Brazil host Olympics games, I no gree because na Rio me know say host am, him come dey vex .Abeg, make him free me.

Mama Nkechi go soon close, make I run arrange wetin belle go wack,so eyes go clear well well. I go like buy water oooo. This world don tire person, i go like enter canoe go obodo oyinbo. i get small money wey i save.......................but if the money no reach nkor, i hear say canoe cost to go there.No wahala, i go say make them carry me reach where the money reach, i go swim the rest. But, mammywater go dey that water and shark , and , and some titus fish, yeparipa, na wa oooo. I for like chop titus fish oooo. Abeg , make i dey here enjoy this condense wey no gree block.

No comments:
Post a Comment